Inec postpone Enugu East senatorial election

Di independent national electoral commission (INEC) say a total over six million pipo never collect dia permanent voters card two days to di Nigeria presidential and national assembly.

Live Coverage

Victor Ezeama and Jelilat Olawale

  1. All five Judges of presidential court unanimously uphold election of Bola Tinubu as president of Nigeria

  2. Breaking, 'Evri tin for Peter Obi petition na just plenty tok' - Presidential court rule against LP & Obi

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Di Presidential Election Petition Court don give judgement on Peter Obi wey be di presidential candidate of Labour party .

    Peter Obi bin raise four grounds of petition but di five man panel resolve all di four grounds against di LP candidate.

    Lead judge of di five-man panel Justice Haruna Tsammani describe oga Obi petition as "mere rhetorics"

    Peter Obi lose to Bola Tinubu
  3. Fake tori wey target judges of di Nigeria presidential election court

  4. Judgement day for di presidential election petition court

  5. Alan Kyerematen tok why e withdraw from NPP presidential race

  6. More on how court dismiss all oda reliefs APM bin ask for

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    BBC
    Wetin we call dis foto, Lawyers for court

    Di Presidential Election Petition Court don dismiss all di reliefs wey APM ask for.

    Dis na afta dem consider di evidence wey dem bring before di Appeal Court.

    Di chairman of di panel of five justices hold say dii entire grounds centre on di issue of alleged invalid nomination of Sen. Kassim Shettima.

    And afta dem consider all di paragraphs of di petition and di reply by di respondents, wetin happun be say being a serving senator of Borno central senatorial district, im nomination dat time as vice president bin amount to double nomination.

    But, dem say qualification on non-qualification of a candidate dey clearly stated for di constitution and Supreme Court don decide upon di issue plenti ttmes.

    No oda law fit contradict di constitution dem tok.

    Di petitioner from di oral and documentary evidence fail to establish any concrete reasons on why dem go grant im prayers.

    On di allegation of APC not conducting any primary election to nominate di Vice president, dme say di petitioner no correct as e dey within di constitutional power of di president to nominate im running mate and di position of di petitioner dey therefore discountenanced.

    Having resolved all di issues against di petitioner, di petition no get any merit, dem tok.

  7. Breaking, Court strike out issue of Shettima double nomination

    BBC
    Wetin we call dis foto, Lawyers inside court

    Di Presidential Election petition Court don strike out di petition of di Allied Peoples Movement for lack of merit and abuse of court process.

    Di court afta dem consider di grounds of di petition wey dwell on alleged invalid nomination of Senator Kashim Shettima as di vice president say di presidential petition court lack di jurisdiction to consider di mata sake of say na pre-election mata wey di petitioner suppose don settle for di Federal High court.

    Court add say di process of qualification of any candidate for any election dey inside di constitution particularly for section 131(1) so diafore, di petition wey APM bring dey incompetent.

    Di five-man panel of Judges don sit down and dem don begin address di issues wey di petitioners raise one by one.

  8. Ogbonge APC politicians dey inside court

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    APC govnors and party chairman Ganduje
    Wetin we call dis foto, Some APC honors showface for court

    Top APC politicians also dey inside court.

    Vice President, Kashim Shettima, Kogi state Govnor, Yahaya Bello, Femi Gbajabiamila wey be current Chief of Staff to di president, Imo state Govnor, Hope Uzodinma show face for court.

    Odas na Festus Keyamo and Nuhu Ribadu.

    APC govnors
    Wetin we call dis foto, Some APC govnors showface for court.
    Nuhu Ribadu
    Wetin we call dis foto, Nuhu Ribadu and Kashim Shettima
    Kashim Shettima
    Wetin we call dis foto, Nigeria Vice President, Kashim Shettima na di fourth Respondent for di petition
  9. Presidential court dismiss petitions of Obi, Atiku & APM for lack of merit

  10. Di five judges wey go decide Tinubu fate on di 2023 presidential election

  11. Why Court of Appeal agree to show presidential election judgement live on television

  12. Tori say former NDDC oga Lauretta Onochie dey stranded for UK - Wetin we know

  13. Palliatives - Items wey Nigeria govnors dey share give dia pipo to take manage subsidy removal

  14. 'Crocodile' Mnangagwa win re-election as Zimbabwe president

  15. Youth corps member no qualify to be Nigeria minister - Falana

  16. Election observers criticise Zimbabwe election

  17. How Lagos Assembly reject Abayomi, Omotoso and 15 odas as Sanwo-Olu commissioner nominees

  18. Who dey President Tinubu top team?

  19. UK police charge Diezani Alison-Madueke wit bribery

  20. 'We go confront her' - CBN react to video wey show Tinubu new minister dey 'abuse' naira