"Stay for house to ‘know your wife better during dis pandemic", Kenya President dey advice men
President Uhuru Kenyatta don ask Kenyan men to take dia time during di new coronavirus pandemic to stay for house and sabi dia wives better.
Tori be say, currently, majority of Kenyans no fit comot for house afta goment say make non essential workers stay for house.
As im dey tok for State house on Friday during Worker's Day, celebration, President Uhuru ask Kenyans to get better relationship with their families. Tori pipo for CitizenKe report am.
"To stay for house dey hard but e no dey easy, but dis na chance to get to know our grandparents, our pikin wey dey house,” President Uhuru tok.
“Make we no dey always look di negatives, opportunities dey to get to know each oda now and better things fit come from am.“ he add am.