South Africa rule out compensation for property wey migrants get Illegally

Wia dis foto come from, EMMANUEL CROSET / AFP via Getty Images
South Africa Govment say dem no go pay compensation for any property wey migrants get through any illegal means.
Minister of Communications & Digital Technologies Khumbudzo Ntshavheni wey also be former Minister for Small Business Development post for her verified X handle on Saturday say "I no dey stammer. Any form of property obtained illegally we no go compensate for am.
Dis dey come afta Nigeria Minister of Foreign Affairs tok say dem go seek compensation from South Africa sake of properties wey Nigeria citizens lose.
African migrants wey bin dey stay for South Africa run comot from di kontri by force sake of plenty protests against undocumented migrants.
Tori be say many pipo leave dia properties and investments behind as dem run for dia lives.
One anti-immigration group March for March wey dey lead di protest bin give June 30 deadline for all immigrants to comot from di kontri
Sake of dat, many kontris don carry dia citizens comot from South Africa including Nigeria.
Foreign ministry tok-tok pesin Kimiebi Imomotimi Ebienfa bin tell di BBC on Wednesday say di two govment go discuss di mata" for di highest levels".
Di Acting High Commissioner to South Africa Alexander Ajayi bin tok for local television on Tuesday say di govment don start to document di businesses and properties wey Nigerians leave behind.
One Nigerian trader wey bin dey wait make dem carry am come back, tok say im don live for South Africa for nearly ten years and im don abandon im business and house becos im dey fear for im safety.
Even though some of di victims get dia documents, di South African authorities say di pipo wey return to di kontri dey stay illegally, but Nigeria say no be true.







